ASUU Extends strike my two month
WIA DIS FOTO COME FROM, FESTUS KEYAMO/TWITTER University lecturers for Nigeria don extend di ongoing strike by anoda eight weeks. One official of di Academic Staff Union of Universities (ASUU) say dem dey extend di strike sake of say goment neva agree to dia demands. Dis announcement dey come as di one month warning strike wey dem bin announce expire on Monday, 14, March 2022. Prof. Abdulkadir Muhammad Danbazau, say di decision to extend strike na to allow di union and goment reach agreement in other to avoid any oda strike in future. Nigeria ASUU Strikes 2009 to 2022 timeline & cause Di latest update on ASUU strike and wetin fit happun next E say two months dey enough to for goment to do di right tin on di matter.